Pidgin Parlour Crypto Podcast

by Pidgin Parlour

Pidgin Parlor na centre of crypto education and culture for the African pipul wey dey speak Pidgin. The show go dey break down plenti crypto concepts wey just dey confuse person into simple forms wey everyday African go fit dey relate with. And all these things go dey for pidgin, the localized language wey over 75 million Africans dey speak. This pidgin parlour crypto podcast dey bring crypto education and culture come inside s ...   ...  Read more

Podcast episodes

  • Wetin be Blockchain?

    Wetin be Blockchain?

    Na interview with Paulito for this episode sha.Paulito na BanklessDAO/Bankless Africa contributor, hin dey crypto space for long, wey hin gather plenty experience for huge crypto organizations like Revewz and DIA. edey well known say even people wey don dey inside Web3 and crypto street no too dey understand cryptocurrencies. Paulito for this interview, yarn us for pidgin wey be say people wey dey streets and all man wey sabi speak pidgin go understand wetin blockchain technology be, how dem take arrange(build) am, how it take dey work and how this blockchain technology take dey power crypto. If you enjoy the episode; no forget to download am, rate us and share with your people dem. The Pidgin Parlor crypto show dey educate the average African on Web3 and crypto topics, dey yarn them the latest updates and tori for the crypto ecosystem, dey highlight projects, ecosystems and man dem wey dey impact and drive the crypto adoption for these African streets. The Pidgin Parlor Crypto Podcast na your plug if you wan dey informed on all things wey concern Bitcoin, DeFi, NFTs, Web3 and others, even as it take dey enter streets inside! Disclaimer: Nothing wey anybody talk for this show na financial advice. Every man wey come talk for this show just dey come yarn hin own opinions. Remember say the number one rule for this Web3 street na to run your own research! Follow our Twitter https://twitter.com/PidginParlourFollow us on linkedIn https://www.linkedin.com/in/bankless-africa-799178233 Join us on telegram https://t.me/banklessafrica Subscribe to our newsletter https://banklessafrica.substack.com/s/pidgin-parlour Learn more about crypto and web 3 on our website https://banklessafrica.com/ Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9S

  • How you fit DYOR for dis bull run

    How you fit DYOR for dis bull run

    As bull run don show, mani pipo go like shook head for inside the crypto market becos plenty opportunity don come, however as una dey plan to make moni, na so scammer dey also plan to scam mani Pipo. Na why e better make una sabi di tinz wey you suppose know for di market and una fit DYOR so una no go shook your leg inside scammer trap. For dis episode we gada talk: 1.)Wetin be bull run 2.)Di first tin wey you suppose sabi if you go shook your moni inside any project. 3.) How you fit DYOR and ape in correctly. 4.)Di tools wey you go need to do well. If dis mata interest you, make una download and listen. Enjoy this episode🎉 Disclaimer - beware Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well. Thank you Follow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlour Subscribe to our newsletter : https://pidginparlour.substack.com/ Join us on telegram https://t.me/pidginparlour

  • Wetin be Bitcoin ETF?

    Wetin be Bitcoin ETF?

    Real world Assets Who go believe say dem go ever approve ETF for di crypto space, dis mata go loud!.  As you don hear say dem don approve BITCOIN ETF, e just be like say dem dey cap cause ETF na mata wey dey popular with Stock, bond, and other investment fund and no be Crypto.  However, as dem don approve dis model, everibodi dey happy because e mean say plenti Pipo go like shook mouth for inside crypto.  For dis episode we gada talk: Wetin ETF be How di approval go affect di market.  Wetin bi di advantages & disadvantages.  If dis mata interest you, make una download and listen.  Enjoy this episode🎉 Disclaimer - beware Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well. Thank you Follow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlour Subscribe to our newsletter : https://pidginparlour.substack.com/ Join us on telegram https://t.me/pidginparlour 

  • Pidgin parlour New year Jamz

    Pidgin parlour New year Jamz

    Happy new year all of na wey dey follow us for Africa and we dey happy say all of una don enter 2024 and you dey kampe. As our culture be for pidgin parlor we go like give una update for everything wey we do for 2023 and wetin you suppose expect for di new year. So make una sit down as we gada reason wetin dey happen for pidgin parlour. Oya download, make una listen and give your Pipo too. Enjoy this episode🎉 Disclaimer - beware Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well. Thank you Follow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlour Follow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9z Subscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5w Learn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com Join us on telegram https://t.me/pidginparlour

  • How NFT go be for bull run?

    How NFT go be for bull run?

    How pesin go pay $1million for pictures, wey una fit just carry anywhere? Na wetin layman dey ask be dat when dem hear about NFT, so today we wan check wetin be NFT and how una fit profit from dis mata in crypto. We don go carry Arrow come studio today as Im dey give us NFT alpha for dis episode For dis episode, una go understand. Wetin be NFT How dis images dey operate How una fit profit from NFT Wetin be di future of NFT If dis mata interest you, make una download and listen. Enjoy this episode🎉 Disclaimer - beware Nothing wey we dey share be financial advice, make una do your research well well. Thank you Follow our Twitter : https://twitter.com/PidginParlour Follow us on linkedIn : https://tinyurl.com/a8m3uw9z Subscribe to our newsletter : https://tinyurl.com/mryh8j5w Learn more about crypto and web3 on awa website https://banklessafrica.com/ Come join we for Bankless Africa - https://discord.gg/pnRDTk9S Join us on telegram https://t.me/pidginparlour