#MUNARS REVIEW & #ARSHUD PREVIEW
#MUNARS REVIEW & #ARSHUD PREVIEW

Up Gunners! An Arsenal Podcast by Tony Doe

Episode notes
#MUNARS REVIEW Na 2-2 e take finish for old trafford on wednesday night as Arsenal been extend dem unbeaten run to 20 games this season. Once again this Arsenal don show say dem be side wey other teams for de pl no fit bully dis season. We bin keep our discipline well for the face of physical opposition, as we maintain our style of play and possession for old trafford. With this draw so, Arsenal don go 20 games unbeaten in all competitions, our longest run since 2007, when the side been rack up a club record 28 matches without defeat. This na the first time this season wey we no win de match wey we take lead, but e no too bad since na for venue where we never win league match for 12 years. As we still avoid defeat so, at all at all na him bad pass. Hard work and togetherness be wetin help the Gunners come through another intensive Premier League tes ... 
Read more